|
|
De former Chelsea winger wey no secure regular place for Stamford Bridge kon wire hin third goal for two matches for de 19th minite bifor Ricardo Rodriguez kon make de result strong well well with de penarity wey hin wire for de 11th minite.
. Na Maximilian Arnod wey kon rap de result up as Wolfsburg grab dia third goal for de Volkswagen Arena as e remain only five minites to reach mortuary time for de game.
Dieter Hecking side wey don improve well well don juss loss four times for 25 league matches and juss dey jolly dia 3-1 win over Inter Milan for dia Europa League lass-16 fess leg match for Thursday, de match wia De Bruyne bin wire two goals.
De team dey jolly 11 points on top of third-placed Bayer Leverkusen wey bulala Stuttgart 4-kondo for Friday.
For Saturday, Bayern Munich kon paint dia betta work for de week as dem give Werder Bremen hot bulala of 4-kondo with goals from Thomas Mueller wey be hin fifth goal for de week, goal from David Alaba, and two late from de Polish international striker Robert Lewandowski
Pep Guardiola side wey don jolly three wins for seven days as dem kon wire 14 goals and juss chop one as dem continue dey maintain dia betta league form and also kon kwalify for de Champions League kwatafinals.
For anoda place, Eintracht Frankfurt kon cement dia place for de upper haf of de table with dia 4-kondo win over third- from-bottom Pderborn.
Mainz kon kolet betta 2-kondo win over Ausburg as Mainz don komot relegation fear for dia side.
Na 2-2 draw Hertha Berlin follow Schalke play as Hertha kon miss betta three points.
Again for anoda place, Cologne no gree Borussia Dortmund as dem kon play 0-0 draw.
No comments :
Post a Comment